Immediately the Joystick crowed and My Joystick growled, the first thing i did was to identify the location of the money……
I recounted the money one by one to make sure it was complete make we no con dey hear issue of spiritual deduction…..
I had no choice than to verify that money again because My dream the night before was quite terrible…. It was just jama jama
….. I was jejely sleeping my own when the dream kicked off…
I was just walking on the road when i saw a packaged gift with my name written on it…
Of course without delay or second thought , i picked it up ,only for me to look back and see two masquerades coming towards with full speed, holding sharp cutlasses …
“ban gbo wo mi, ban gbo wo mi( give me my money,give me money)..
For where ???
phiam !!!, we started the temple run, dream version …..i held onto the package tightly as the masquerades chased me and trust the boy for anything awoof, me sef no slack as i turn usain bolt for the matter….
The rest part i no remember but i just wade the thing off…. Aimoye dreams..
If all dreams dey come to pass, all those dreams wey i go dey fight lieu keng or they act chinese film and do all those jet li tricks abi the sweet ones wey i dey get with dija for don come to pass… :(
abegi…
All those dreams wey i go dey chop pounded yam with egusi soup and smoked frog lap, food wey i no dey see chop for real life :(
i go even wake up and chop mouth to see if any remain from the dream but nothing…
Shior…. Ala go jare…
And with that, for the first time in 3 months, i did my devotion….
Haaa….. You dey laugh ?… Ani make person sha clear any appeareance of evil…anyway na way.
Picked up my daily devotion wey dust don full am and used john 3 vs 16 as the devotion text…
I spent 30 mins singing various songs and almost one hour praying; then ended it with seven powerful halleluyahs…
Am insured jare….;D…
With that,. I set off to the expenditure and budget of the money and things i needed to get as soon as possible..
person wey talk say money no be everything na bastard…:(
Despite the fact dat it was cassava grates i drank last night, immediately i withdrew the money , even till this morning, Hunger dissapear.
Bank never Call me, nobody don disturb me say so so so and so money entered ki ni kan ,ki ni kan…
Jesus is Lord..
Shirts-5000
gold chain (mallam)-2000
shoes-20,000 naira
nigerian jersey (two) – 2500 naira
airforce1 album -100 naira
tithes, offering and church donations – 1500 naira
……
I was still drafting the budget when i received a message via pm from nairaland…
It was a message from one of the powerful and respected romanceland babes ( i will use secret to cover her identity here)
This girl had various threads dedicated to her on nairaland and guys no dey allow am rest because of her beauty and asset.
Her elegant smile and massive backside is enough to drive any man crazy,,,
Bet why me ?
i was shocked because i don pm this babe now e don enter 3 wks, wey she con dey reply now…
I checked the msg and chillaxed for like 30 mins before i replied may she no go dey reason herself special….
Hi, boo osin
hello….
Hi, Do you stay in abuja ?
Yes i do…….
The next message wey i go see shock me no be small….
To Be Continued…
No comments:
Post a Comment